![]() |
Trump administration threaten Harvard wit foreign students ban afta e freeze funding - wetin be im demands |
Di US goment don threaten to ban Harvard University from enrolling foreign students sake of di institution say dem no go bow to demands from Donald Trump administration.
Di White House don demand di oldest university for di US to make changes to hiring, admissions and teaching practices wey e tok say go help fight antisemitism on campus.
Homeland Security Secretary Kristi Noem on Wednesday accuse di Ivy League school say dem dey "threaten national security" and dey "bend di knee to antisemitism".
Di Secretary also demand records on dia foreign student visa holders "illegal and violent" activities.
International students dey make up more dan 27% of Harvard enrolment dis year.
Get in touch with us for your music promotion and social media Boosting.