Di racial kasala between Musk and South Africa over Starlink

Ghhitzmedia
By -

Di racial kasala between Musk and South Africa over Starlink

 Di kasala between Starlink boss Elon Musk and South Africa ova failure of di company to launch stems for di kontri from di black empowerment laws of di kontri fit be one factors wey dey behind di diplomatic issues between di US and South Africa

For im more dan 219 million followers for im social media platform X, Mr Musk bin make di racially charged claim say im satellite internet service provider "no dey allowed to operate for South Africa simply becos I no be black".


But di Independent Communications Authority of South Africa (Icasa) - one regulatory body for di telecommunications and broadcasting sectors - tell di BBC say Starlink bin neva submit any application to get licence.

As for di foreign ministry, e tok say di company bin dey welcome to operate for di kontri "so far as dem follow local laws".


Get in touch with us for your music promotion and social media Boosting.